Friday, September 24, 2010

Speak English

Writing these note after remember a conversation between Roommates @ Crawford University. The following conversations ensues between three friends
Id: omo that class no tite o,chris just dey yarn nonsense
Osanle: i dey hayse gan,wetin we go chop
Obi:yomi you too like food
Id: (thinking) we don too dey yarn broken for these room,let me suggest something
Obi: id,ow far wetin do u?
Id: omo i bin dey reason am,when last we don talk english for this room?
Obi and Osanle: na true oh,we self just reason am now,so wetin?
Id: make we change na,abi wetin una think?
Osanle:me i dey hungry oh
Obi: e no go work
Id: make we just try starting now
Osanle: ehn okay
Obi: anyhow
Id: so when is the next class?
Obi: LOOOOOOOOOL
Osanle: (kiping it simple) don't know
Id: so guys what should we take for lunch
Obi: still LOOOOOOOOOOL
Osanle: let's go to the Cafe
Id and Obi: LOOOOOOOOOOOOOL
Osanle: Wetin, sorry what is making u guys laff?
Id and Obi:LOOOOOOOOOOOOL
Osanle: me im stepping out now
Id:let me get dressed
Obi:finally,you guys should chill for me
Id and Osanle: we are waiting
Obi:so u guys are serious wiv this english stuff?
Id and Osanle:obviously
 They all step out get to the cafe and eat then come to the room and the following ensues
Obi: where is aristo?
Id: probably doing what he does best
Osanle:that being?
Id: U know what i mean
Obi: LOOOOOOOOOOOL
 Door Opens enter Aristo
Aristo: Obi ow far u go blaw?
Obi: u get mouth
Id and Osanle: obi ow far u don forget say no broken again?
Obi: LOOOOOOOOOL make una dey dere dey dull, eno fit work
Id: me sef don tire,i don dey get headacheOsanle: LOOOOOOOOOOL

Eventually back to square 1.........remembering the good  old days more to come
Missing u guys gan oh.......Read and Lafff

No comments:

Post a Comment